Saturday 18 June 2016

CHARACTER

Mr. B: Hmmm, what is that scent? It seems it's a mixture of Flower bomb, Burberry Brit, Whaaaat, even, Chanel Chance....on just one human being.
   Wait, wait, it seems like there's a little touch of Bulgari BVLGARI rose essentielle, all these are extremely expensive perfumes; no one cost less than a Hundred dollars....
  You know I am into Perfume business, you have to know your scents.

Obinna: Ewo! You no mean am, so you wan tell me say, on top that woman na half a million on just scent wey breeze go soon blow comot...Na wa o...Money miss road.

Mr. B: Yes o, My brother.

Obinna: Ah! And you know the thing wey pain me pass be say, as she fine reach with all those scents wey you dey count, her heart be like stone. She wicked ehn, so tey, the Devil carry second position.

Mr. B: What do you mean?

Obinna: Eh hen, as you see the woman, me sef I know say she get money but as you see her so, her middle name na "Alaroro" a.k.a "Aka gum" a.k.a "Stingy koko", She stingy ehn....

E no stop there o, you see that Jeep wey she go dey park for anoda persin domot, and no be say, she no get parking space...No be her own.
  I hear say, Na for the husband first wife wey she pursue comot.

Then, you see how she go dey smile, Na lie o.
If she smile for you, bros, bone your face, because the day you smile for am, Na so you go smile away your money.
   Infact, the next time she pass your side, close your nose, no dey smell her scent... You no know wetin she don put inside the scent, maybe Na even touch and follow scent...

Mr. B: Oh My God, She must really be a wicked woman.

Obinna: Bros, in short, as you see her so, with that her innocent face and perfume, Na she gan gan be the devil's pikin....

"A good reputation is more valuable than costly perfume or a fat bank account"(Ecc. 7:1, NLT.MSG)

Shalom....